Home Politics PUBLIC WARNING TO BOYLOAF AND JUDE GBABOYOR AND THERE LIES

PUBLIC WARNING TO BOYLOAF AND JUDE GBABOYOR AND THERE LIES

77
0

Na everybody don see say one man wey dem dey call Jude Gbaboyor don dey waka for social media dey talk plenty lies, dey spread fake gist about Tantita Security Services, High Chief Government Ekpemupolo (Tompolo), and the respected Coordinator of the Presidential Amnesty Programme, Chief (Dr.) Dennis Brutus Otuaro.

Make we talk am straight—Tantita no kill anybody for Rivers State. Nobody dey kidnapped or locked for any illegal prison like this man dey talk. All na lie wey he wan use scatter the peace wey dey this region. Tantita dey do better job—dem dey protect our oil, stop thief thief, and maintain peace for Niger Delta.

Under the leadership of Tompolo, Tantita Security don change the game for Niger Delta. Dem don stop illegal bunkering, pipeline vandalism, and oil theft wey be the real enemy of our development. The whole world don dey notice say Tompolo na man of action—no noise, just result.

Dem no just dey stop crime, dem dey give our boys job, skill, and new hope. Plenty youths wey for dey follow bad way, now don turn better person through this Tantita work. Na true empowerment be this—one wey dey give both bread and peace.

Jude Gbaboyor, we dey ask you—wetin concern you with Tompolo or Otuaro? You wey dem drive comot from Amnesty Office because of the way you take handle things anyhow. You wey chop wetin no be your own that time, now you wan bring down people wey dey do better pass you?

This Jude wey dey run from video to video, na just public disgrace. Him nose big like drum wey dey beat lie everywhere. Him ear long like bat own, e just dey waka dey pick gossip from corner to corner. Him head be like tanker—full of jealousy and confusion, and him eye red with bitterness like person wey dey vex say progress no reach am.

As for mouth, e wide like pig own—e no dey ever rest. Every time na blackmail, fake talk, and insult. Person wey no fit manage him own life dey come online dey attack men of vision. Even demons go shock for the kind evil character wey dey inside this man. Envy and hate don carry overtake am—he no get direction again.

Chief (Dr.) Dennis Brutus Otuaro, since he enter office as Amnesty Coordinator, na progress everywhere. He don restore calm, build relationship with ex-agitators, and carry everybody along with respect. No be noise, na result we dey see.

No be only peace, Otuaro dey empower our youth with training, jobs, and leadership development. Many of our brothers and sisters don go school, learn skill, and become useful again through his programme. He dey carry Niger Delta youths from street to standard. Na true leader be that.

We dey call on police, DSS, and all security people make dem look into all this nonsense wey Jude Gbaboyor dey talk online. This kind fake talk fit cause wahala for our region if dem no stop am quick.

To our Niger Delta youth, abeg make una shine una eye. No follow person wey don fail him own self. No let one bitter man deceive you. Support people wey dey do good work. Follow peace, progress, and unity.

The Niger Delta don move forward—no allow anybody drag us go back with him bad belle and lies.

We stand gidigba with Tantita.
We stand with Tompolo.
We stand with Chief (Dr.) Dennis Brutus Otuaro.

Jude Gbaboyor—carry your bad belle witch go far. This region no be your playground.

Signed:
Leader Ebi John

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here